How Sunday? How Body?

Dem say Boko Haram don poison beans after I don buy half bag for house o. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am. 45 mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, Hey! I run enter
house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem, chop walnuts with the shell no time to crack, swallow moringa leaf and seed join with aloe vera as treatment combo. Garlic and onions be like sweet candy for my mouth. I come dey sweat as if na oven be my bedroom. I dey think say my life don finish. I come outside. Na im gate man com dey tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me!

4 thoughts on “How Sunday? How Body?”

Leave a Comment

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.